Temper hot, temper hot but e no still fit boil beans. Sun too hot no mean say fowl go lay boiled egg.Įscort me, escort me, na im slave trade take start. Monkey no fine, monkey no fine but im mama like am. To craze no hard, na to trek be the wahala. Na footballer wey ball dey im leg camera dey follow. You no go call goat brother just because you wan chop goat meat.Į go land, e go land, na im make butterfly take enter bush. Na the same hot water wey dey make egg hard dey make Potato soft. Pikin wey hide cane wey dey for house forget say bush near.Ĭow wey rush go abroad go come back as corn beef. No matter the size of elephant, e no fit cause earthquake. Na village wey native doctor know e dey disappear. You see “thank you”, you dey find “very much”. The difference between Kpekere and plantain chips na packaging. Use rope tie goat, tie goat rope, na the same thing. Mosquito wey no dey hear word na im dey follow dead body enter grave. This one good, that one good, na im make mad man load plenty. No food for lazy man no be for pikin wey im mama dey sell food. Person wey dey chop egg no know say yansh dey pepper fowl. Woman wey dey find pikin no dey wear cloth sleep. I dey shame, I dey shame, na so person take dey die in silence. Monkey smart, monkey smart, na because tree near tree. No be who first call Police dey win the case. Na wetin dem pass through make them different. Jollof Rice wey dey bottom pot today, go dey for top of cooler tomorrow.ĭo you know who I am, do you know who I am, na so traffic dey take start.Īkara and moin moin get the same parents. E blow you small, e blow your neighbour small. Lean on me, lean on me, no mean say make you suffocate me.īring Suya, bring Suya, na cow body dey suffer am. Person wey belle full today, go hungry tomorrow. Nigerian Pidgin English ProverbsĬhop this man money, chop that man money, na so ashawo dey start.įeel at home, feel at home, na so visitor take dey spoil television. Check the Nigerian Pidgin English Proverbs out, you will totally love them. Who doesn’t love the Nigerian Pidgin English? Is it the fact that it is so interesting to listen to or that it is the language on the informal Nigerian streets that give the speakers bragging rights? Yes, we also know a lot of Nigerian will want to give the *tush* or civilized facade and reveal that Nigerian Pidgin makes then uncultured and uncivilized when it is spoken, but that does not take away the beauty in the Pidgin and the need to flaunt it as much as we like.įor those who are Nigerian Pidgin English inclined, Facebook user, Dionne Obodo shared these Nigerian Pidgin proverbs and it reminded us of how beautiful the Pidgin English is.
0 Comments
Leave a Reply. |
AuthorWrite something about yourself. No need to be fancy, just an overview. ArchivesCategories |